Hot Aproko Gist (Vol 13) don land, with Inspector Nifemi!!!



Aproko gist volume (13) don land again oooo. ....

How far Lailans? Abeg who get gist make he gist us nau....Lolz

Some  Lailans be like(Is she alright?) How Aproko go dey ask us for gist.
Abeg gist us as he dey hot jawe.....O ya nau,lets go dere. ....

Lisa Peters baby,how your hot new neighbor. ..I hope bros uncle is paying his due....we see as u dey blush about d guy on anything  goes.I just dey  help you imagine him 12packs.But no forget David kachikwu advise oooo....He say make u no get belle for neighbor but allow neighbor do the needful(No Babymama ooo)Anyways, Aunty lisa...How Hector  twitter? Are u still crushing on him or neighbor neighbor ti take over....?

My zombie huntress with beautiful soul,how is d kiss from brother  Austin d other night? Am just making sure the shape of ur mouth is still intact....because the comment  (Kiss me tonight)appear like 3times..Lolz

This my mouth sef?God help me.....Back to the matter. ..Uncle Babs stay dere and be asking how is my pam pam...like say u no sabi say her birthday na June 21st.Just respect ursef and send all lailans free recharge card on that day...No just dey say where is my pam pam...try be in ur best behavior on dat day too...*smiles *

Martha  baby,I sight you all day and everyday. ..I never see lailans wey bold like you. ....Anyways,I will contact you for those beautiful wigs...I need to rock it on Pamela's birthday. ... (I hope Rooney will be friendly once he sight my wigly look...Una go fear grammar )

Ogechi baby, happy birthday to you....keep having fun gurl.
EA Event,God bless ur hustle....
All them lailans,Ed-Dreams and Co wey dey school. .May God Almighty continue to Order una steps. .Amen

I salute you all.....One love

Inspector Nifemi. ....


from Nigerian: Breaking News In Nigeria | Laila's Blog http://ift.tt/22Pf8Q3
via IFTTT
Previous
Next Post »
0 Komentar